TIMI DAKOLO – Nothing Dey Spoil For God Hand Lyrics

 

Nothing Dey Spoil For God Hand – Timi Dakolo

people dey ask me sey, wetin dey make me shine

wetin dey give me joy like this, wey I dey jump and shout.

 

people dey wonder why, why I still dey smile

in this aggravating, wild times, nothing dey touch my side.

 

when I try to dey fix am, when I been try to dey run am, e no work , e no work for me

 

when I try to help myself, I realize sey no be by sense

na him I drop am for God hand oh

Because nothing dey spoil for God hand oh( nothing dey spoil for God hand oh) 2x

 

 

if you give am,

E go keep am

if you spoil am, E go fix am

 

 

people dey ask me sey, wetin dey give me vibes,

where I dey get this energy, when things dey fall apart (when things dey fall apart e e)

 

TIMI DAKOLO – Nothing Dey Spoil For God Hand

 

people dey wonder how,

how I still dey smile

through this dark and lonely night, my light still dey shine.

 

 

I take my problem, leave am for God hand

the one wey pass me, na there I drop am oh

na so I do am oh

 

 

I take my problem, leave am for God hand

the one wey pass me ,na there I drop am oh

 

I leave am for God hand oh

Because nothing dey spoil (nothing dey spoil for God hand oh)

 

 

Nothing dey spoil for God hand oh(nothing dey spoil for God hand oh)

if you give am , E go keep am

and if you spoil am, E go fix am

 

Because nothing dey spoil for God hand oh(nothing dey spoil for God hand oh)

Nothing dey spoil for my God hand oh( nothing dey spoil for God hand oh)

 

if you give am , E go keep am

and if you spoil am, E go fix am

More Artists You May Like

Leave a comment

Need Help? Send a WhatsApp message now

Click one of our representatives below

Joshua Daniel
Joshua Daniel

Customer Care

I am online

I am offline

Blessing
Blessing

Marketing support

I am online

I am offline